Monday 24 November 2014

SHAKARA (A poem written in pidgin english)


Vero
I still dey remember that time when we small
when nah pant you dey use dey waka
you and Rukevwe go dey play hide and seek
for our backyard that time

Vero
nah me and you been dey do mummy and daddy
you remember?
that time under our dinning table
wey we dey do wetin we no understand
all we know na say the play take style sweet

Vero
nah me oo
that time wey Fraiyo beat you for school
wey I mumu go form Van Damme
dem panel beat my body
wey for three weeks i no fit tanda sef

Vero
so na me you come dey form for
unto say you don enter school
and me still dey hustle for here
you come dey follow me dey yarn oyinbo
for your mind now i no hear English

Vero my Vero
God dey ooo
nah because say i never hammar
na im dey make you do all dis shakara
but one day i know say
anyhow e take be tins go everly gel for me
                                                                
                                                                     eDriiz...

No comments:

Post a Comment